Tori 4 Pidgin: Everi Everi Don Set for 2019 Bet9ja Royal Cup Quarterfinals

By Jahrock Ujewe,

Everi everi don set for de 2019 Bet9ja Royal Cup quarterfinal stage, as all de matches go happen between 16 and 23 November for inside Agbor, Kwale, Oleh and Warri stadium dem.

According to wetin de Local Organizing Committee, wey be LOC, yan tru dia talk talk persin, Jahrock Ujewe, de first quarterfinal game go shelle between Young Professionals and Bobbies United for Agbor Township Stadium on November 16 by 12noon.

Jahrock talk say two days later, wey be November 18, De Unique FC of Asaba go play Rolly FC of Koko inside Kwale Township Stadium.

Dat game go set by 12noon dat day.

E still say Osevan FC of Kwale and Young Shall Grow FC of Ibuzo go try trick each other with their style, when dem meet for Warri City Stadium on November 21 by 12noon.

De talk talk persin say Lord Honour, wey many pipo don believe say go win de cup, go try delete Ekete United comot from road on November 23 for Oleh Township Stadium.

E talk say dem don mark dat match as de final before de final, as de two team sabi tap leather like de way e be for street.

On Wednesday, wey be November 6, 2019, Ekete United use 3 – 2 victory waka pass Mega Stars for de first game.

While for de second encounter, Young Shall Grow FC no fear face, as dem wire Delta Eagles 3 – 0.

De 2019 Bet9ja Royal Cup, wey dem tag Delta Premier Grassroot Soccer World Cup, go end on December 14 with de final inside Stephen Keshi Stadium for Asaba.

Related posts

Leave a Comment